Sunday, September 27, 2015

Sunday Reasoning: Time For Some Mega Pidgin Proverbs! ENJOY!

So, since today is Sunday, I think we should take a good 'ole time to enjoy some African proverbs in pidgin english. Below, are the few compiled so enjoy and add yours after reading!

1. Na for old age ashawo dey know the value of pikin.

2. Woman wey never see problem...na im dey still hold breast run.


3. Woman wey dey find pikin no dey wear pant sleep.

4. Rat wey follow lizard enter rain, Na later é go hear am.

5. Na for afternoon dem dey find black goat.

6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay boiled egg.

7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD.

8. Pikin wey him mama back cross water, wey say him match fish, wetin him mama go match?

9. Small pikin wey dem carry for back no know say the journey far.

10. Person wey don faint before no be stranger to death.

11. Person wey chop belle full, no know wetin hungry man dey see.

12. No be as woman dey close eye enjoy
sex she dey enjoy labor pains. 13. Yansh no get teeth but e dey cut shit.

14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if nobody hail am!! é go hail himself

15. Toto water small, but é reach prick take baff.

16. IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND, SHE GO TAKE BOYFRIEND DO HUSBAND.

17. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck.

18. Na cricket tell him children say, No matter how ground strong, Them no go sleep outside.

19. Pikin wey say him mama no fine they use style call him papa blind man.

20. No be eye wey dem take chop eba dem take dey share meat.

21. Person wey use Elephant set trap, na him know wetin he wan Catch.

22. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open.

23. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS, BUT STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW BOOK.

24. Dem no dey tell tortoise say race don start.

25. Dem no dey tell blind man say salt no dey for food.

26. Before you see monkey, monkey don see you.

27. Thief wey jump fence enter house where owner dey wait for am, no go jump again.

28. If pikin say he sabi die, him papa sef go tell am say him sabi bury. 29. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im dey kill am.

30. If e be like say everybody dey craze" na you dey craze.

31. Meat wey you dey forbid, no use your teeth cut am. 32. My thing and our thing no be the same oh.

33. Na happiness dey make prick stand.

34. Na as goat stand for market dem dey price am.

35. Craze no hard to form, na the trekking be wahala.

36. Its a small world!! No mean say you fit trek from Naija go London.

37. No matter how hot your temper be, e no fit boil beans. 38. Chicken wey run from Borno go Ibadan go still end up inside pot of soup.

39. Today’s newspaper na tomorrow Suya wrapper.

40. Akara and moin moin get the same parent, na wetin dem pass through make dem different.

41. Nama wey run go overseas go come back as corned beef

I can't stop laughing, Oya add your own!

12 comments:

  1. Ahahaha! Most of dem got me cracked up. Buh d one that got me d most. Is "Woman wey dey find pikin no dey wear pant sleep". That rili got me. Have you heard the New Nigerian National Anthem? Anticipate #PromiseLand

    ReplyDelete
  2. My own is "Cock wey never reach to cry wey cry, na headache go kill u. Ahahaha! Yansh no get teeth bu e dey cut shit. Ahahahaha! I'm gon have to save dis page sha! I need to be chiping these things into my everyday vocabulary. Have you heard the New Nigerian National Anthem? Anticipate #PromiseLand

    ReplyDelete
  3. Imao..very funny......very funny .....hmmmmmmm
    Who know come ,,know go know

    ReplyDelete
  4. Pikin wey say him mama no go sleep, him too no go sleep

    ReplyDelete
  5. Ok nao de say shit no get bone but if you Match am your foot step go change

    ReplyDelete
  6. I no fit ask frog for chair, wen u dey see say him too dey squat..person wey swallow full coconut trust d size of him anus....na only foolish fly go follow dead body enter grave...I got a lot more but i'll stop here

    ReplyDelete
  7. Hahahaha,any how e b ogoro must jump

    ReplyDelete
  8. Them no dey tell blind man say rain don start.

    ReplyDelete

===> Follow Chi-Chi Nwa' Africa On BBM Channel C0032A9BF To Get Update On Latest News, Entertainment, Sports, Opinion, Relationship, And Lots More...